Di govnor of Lagos state, Nigeria commercial capital dey hope to come back for a second term wen residents of di state go to di polls on Saturday, ...
E add say di construction of di 4th Mainland Bridge dey ongoing wey go connect Lekki to di Lagos-Ibadan Expressway.โ One of di projects wey di administration embark on na di first Phase of di Blue Line Rail to ease transportation for residents for di state. Dis dey important sake of di plenty traffic wey residents dey experience on di road. Oga Sanwo-Olu also na alumnus of di prestigious Havard Kennedy School of Government, London Business School and di Lagos Business School. Dem born oga Sanwo-Olu on June 25, 1965 for Lagos State. Since 1999, na only one party don rule Lagos.