Nigeria dey vote who dia next leaders go be inside presidential and legislative elections. Di elections wey before be dey dey between di two main political ...
Dem announce final results on di third day afta voting for di last two elections, but dem fit come in earlier dis time sake of BVAS, wey also dey upload vote results directly to di Inec website direct from polling stations. Dis na di first time Inec go conduct national elections wit di use di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS), one facial and fingerprints technology wey dem tink say e go improve transparency as e go make am harder for politicians to rig di process. Di election don see huge interest from first-time voters and young pipo - one third of di 87 million eligible voters dey below 35 - wey fit lead to high voter turn-out than di 35% wey dem record for 2019.